Verse 1 Nepa, na lie you don start again, every night around 8pm I don pay my last bill with the money i suppose Go use buy garri for my sunday night meal See me no money to buy some kerosine No battery for my touch light I dey go malaam for credit Aboki won use im horse whip Trash me for back i con run go the streets ehh Okada man wait, abeg stop make you carry me go mushin I dey go nepa office Me and them go fight today I dey vex like that pikin don pour me pepper spray God help them if dem never bring my light by the time i con reach my house When you watch football [dem take light] Thriller [dem take light] Comedy [dem take light] Music [dem take light] Chorus 4x Nepa bring back my light bring back my light I don tire o Verse 2 I don reach nepa office For desk receptionist jus they give me long tory Where the man in charge chei una they find serious trouble Abi you don forget say me i dey hussle as i dey now Hunger they wire me Sote i fit eat a horse that one na metaphor Jokes apart biko wey my light I go scatter the paper for your table I dey talk you, ma dey sit their dey watch cable My situation dey very unstable, oga you dey hear me so Oh boy, shutup abi na only your light wey nepa take If i land you one you gon shake like olumorock Wey king kong scatter, you dey think say because i dey skinny I no go fit batter You and your colleagues na thief una be, ole barawo You don fap my light fee wey my light Repeat Chorus Verse 3 [Ay] Na any time nepa fit touch light Reason people hold on to touch light Wahala start wen i start to touch light Food money dem go take am buy candles People carry lantern and okada carry bike handles Candle wax plenty on top table Like channel on top cable Darkness nepa na clothes and liod in turn tables Dem dey make people uncomfortable Na waa i dey here dey form syllables And rap about light, electricity na part of our lives Situation still dey highlight Facts about light When light come people be like up nepa when dem mean Frock nepa cause dey take light and leave hot tempers in block letters You no fit dey your room like penpals Generator necessary inside house like ink in pen pal Repeat Chorus 4x